How TDC has started DOING what the one presently in the Brick House could not do.
——————————————————————————————————
“The first day we come here people dey cry, the suffering dey too much. Everybody wey we dey see here Na una be the representation of Nigeria. When everybody dey look Nigeria na una them dey see; when everybody look Rivers State na you. So if you dey cry, Rivers State dey cry, the same with Nigeria. If you dey laugh, Rivers State dey laugh, and Nigeria too dey laugh.
“So our responsibility be sey if we want Rivers State better, we get to make your life better. If we no fit make your laugh, then Rivers State no fit laugh. If we dey make you laugh then Rivers State go cry.
“Our responsibility na sey anything wey affect you, affect us too. The last time we come una dey cry badly and everything una work for, fire carry am go. The Bible say we’re there is life, there is hope. When you look around, una life done dey come back small, but una still lose something.
“I make two promises that day; the first one be sey I go come give una something wey go take una manage so that una go dey continue business, so that una business no go die.
“So we ask una leaders to tell us how many people dey affected, them give us the list. We no ask them sey na only party people dey the list. As them give us the names, we calculate sey Wetin we get to make una manage dey go na 15million naira.
“The second promise na promise wey we go fulfill when we enter office.
~ Tonye Patrick Cole, addressing traders of burnt Fruit Garden Market in PH recently.
With Tonye Cole as governor of Rivers State #WeGoDoAm for Rivers people to enjoy.