Uk court don find Nigerian Senator Ike Ekweremadu and im wife plus one medical “middleman” guilty of one organ-trafficking plot, wey involve one 21-year-old man wey dem carry come UK.
Dem find di 60-year-old senator and im wife Beatrice, 56, and Dr Obinna Obeta wey be 50-year-old guilty for di Old Bailey for conspiring to exploit di young man from Lagos for im kidney.
Prosecutors say dem wan remove di young man organ and give to di couple daughter, Sonia, wey be 25-year-old.
Dem carry di victim wey be street trader for Lagos go UK last year to provide im kidney for inside one £80,000 private transplant for di Royal Free Hospital for London.
Dis tori still dey break we go dey update am wit more details. Abeg refresh di page for di fullest version.